Confidentiality - E no just be one part of the system, e be property for the whole system as e dey. Even though dem dey use di latest cryptographic tools to protect communication for one level, e no fit dey totally protected if information come dey leak for other levels. Nym dey aim to create one global system wey go ensure say privacy dey for all internet traffic for different levels, and dem go fit scale am reach the whole world.
Nym get two important parts:
- Decentralized mixnet network: This component dey give users extra security for dier network traffic for level 0, e better pass the technologies way VPN and Tor bring. Nym mixnet dey work based on one traffic-mixing pattern, where nodes dey mix and send packets in one way wey dey hard to analyze time and space. Mixnet nodes dey collect reward for this service with NYM tokens, e dey motivate people with economic incentives to join and make sure say the network dey stable***.***
- System wey dey use token for credential: Dis component dey provide privacy wey dey work for application level. Users fit enter Nym mix network using NYM tokens. Nah NYM tokens dey use pay for network services like traffic mixing. Dem be important part of how network services dey work, and dem dey make sure say people get reason to join and dem stop spam for the system. Nym no just dey improve privacy for network level alone, e still dey provide beta levels of privacy pass standalone mixnets or isolated applications wey dey enhance privacy. The infrastructure wey dem get fit join plenty people wey dey use different applications into one big crowd, e fit make users no fit tell who be who and e go improve privacy well well. One important thing about Nym na how e dey operate without central control. The Nym network, e no dey require permission, and e no need trust because e dey use blockchain to dey manage all the mixnet credentials and operations. Dis one dey guarantee say the network dey hide people identity and e no fit easily fall into the hands of people wey wan spy, even if strong enemies wan try control the whole network.
Overall, Nym is the first universal system for providing privacy at all levels. With di use of a decentralized mixnet and tokenized credential system, Nym dey create one way wey e go encourage people economically and secure, to protect dem privacy. E dey make sure say internet traffic all over the world dey private and e dey fit expand well.